Psalm Chapter 100
Dis Na Hymn Of Praise
- Dis na Psalm of tanks-giving. Make una shout wit happiness to Baba-God, all di earth.
- Make una jolly dey serve Baba-God;
carry songs of happiness come meet am. - Make una know sey Baba-God na Oga. Nahin make us, and no be we make awasef. We be hin pipo—di sheep of hin farm.
- Enta hin gate wit tanks-giving and hin
house wit praises; give tanks to Baba-God, con bless hin name. - Baba-God dey good, and he dey sorry-for pesin forever; and hin truth dey last for all generations.