Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 112

Abeg click here to share dis post

Pesin Wey Dey Fear
Dey Prosper

  1. Praise Baba-God. Blessings for di
    man wey dey fear Baba-God, wey
    Baba-God commandments dey tortori
    am.
  2. Hin pikin go strong kakaraka for earth; di generation of pipo wey get clean-hand go dey blessed.
  3. Wealth and plenty moni go dey inside
    hin house, and hin good works go last
    forever.
  4. Even for inside darkness—light go show for pipo wey get clean-heart; he get fine heart, get soft-heart well- well, and he get clean-heart.
  5. Beta pipo dey kind, and dem dey borrow to odas, he go do hin business wit hin church-mind.
  6. Surely, no-shaking for am; dem go
    remember good pipo forever.
  7. He no go fear any bad news; hin heart
    dey kamkpe—to trust Baba-God.
  8. Hin heart stand gidigbam, he no go
    fear until he see hin wish for hin
    enemies.
  9. He don scata hin gifts abroad to poor
    pipo, and dem go remember hin good
    works forever; and hin horn go get levels wit respect.
  10. Wicked man go see am con para, he gobite hin teeth wi

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website