Psalm Chapter 113
Baba-God Dey Carry Humble
Pipo Go Up
- Praise Baba-God. Cut-cap—oh servant
of Baba-God, praise Baba-God name. - Make we praise Baba-God name, from
now and forever. - From where di sun dey rise—reach
where e dey go down, make dem praise Baba-God name. - Baba-God high pass all di nations, and hin levels high pass di heavens!
- Who be like Baba-God awa Oga—wey
sidon for king-chair wey high, - wey dey look down to see di heavens
plus di earth? - He dey raise di poor from dust, con carry pesin wey need epp from yama-yama;
- he make dem sidon wit princes, wit
princes of hin pipo. - He settle woman wey no fit born pikin
for her house—as mama wey dey happy wit plenty pikin. Make una praise Baba-God.