Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 60

Abeg click here to share dis post

Dis Na Prayer Afta Defeat

  1. To di chief musician. Set am to di tune of, “Lily of di Testimoni.” Dis na poem of David. Na for teaching. Wen he fight against Mesopotamia and Syria of Zobah, and Joab come back—con kill twelve thousand Edomite for bottom of di mountain wey dem
    dey call Salt. You don fashi us, Oh Baba-God, you don break us down; you no happy wit us—ginger us again!
  2. You don shake di land, con tear am open; heal di pieces, e dey shake.
  3. You don show your pipo hard tins; you
    give us ogogoro—wey make us confuse.
  4. But you don raise flag for pipo wey fear you—and dem go show am becos of di truth.
  5. Save wit your right hand and hear
    me—so dat those pipo wey you love go free.
  6. Baba-God don tok from inside hin
    holiness: “I go happy; I go divide Shechem, con measure from bottom of di mountain of Succoth.
  7. Na me get Gilead, na me get Manasseh. Ephraim na my helmet, Judah na my staff.
  8. Moab na di basin wey I dey wash my
    hand put, I go pull my shoe for Edom,
    Philistia dey shout wit victory becos of me”
  9. Who go carry me go di city wey dey
    protected? Who go carry me go Edom?
  10. No be you, Oh Baba-God, you wey don
    fashi us? And you wey no gree follow our army waka?
  11. Give us epp from wahala, becos man epp dey useless.
  12. Wit Baba-God we go get di victory, and he go march awa enemies for ground.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website