Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 61

Abeg click here to share dis post

Full-mind ForBaba-God Protection

  1. Dis na for di choirmaster. Wit
    instruments wey get strings. Dis na Psalm of David. Hear my cry, chai Baba-God, listen to my prayer.
  1. From where di earth end—nahin I go cry to you, wen my heart don heavy. Carry me go di rock wey high pass me.
  2. E don tey wey you be my strong-house, you be strong tall-building against my enemies.
  3. I go stay inside your house forever, con hide my head for under your feathers wey I trust.
  4. Oh Baba-God, you don hear my
    promises to you, you don give me di
    blessings wey belong to di pipo wey dey fear your name.
  5. You go add-join di days of di king life,
    hin years go last for many generations.
  6. He go dey wit Baba-God forever; use
    your mercy and truth take protect am.
  7. So I go sing praises to your name forever, and I go keep my promises day by day

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website