Psalm Chapter 94
Baba-God Na Di Judge
- Oh Baba-God, di God wey get revenge.
Chai Baba-God wey dey revenge, shine come out! - Rise up, oh judge of di earth; punish di
pipo wey dey make- mouth. - Oh Baba-God, how long wicked pipo,
how long wicked pipo go dey win? - How long dem go dey miss- yarn? All di badbelle pipo sabi make-mouth well-well.
- Oh Baba-God, dem break your pipo to
pieces, and dem wound di pipo wey be your own. - . Dem kill widows and foreigners,
plus pipo wey no get papa. - And dem tok sey, “Baba-God no dey see; di God of Jacob no dey understand.”
- Understand dis, una wey no-get- sense for di community; una wey be swegbe, wen una go get sense?
- Abi you tink sey me wey give una
ear—no dey hear word? Abi me wey give una eyes—no dey see? - Abi di Pesin wey dey command di
nations—no dey correct pipo? Abi Pesin wey dey teach man—con be olodo? - Baba-God know all di tins wey man dey plan for hin mind; he know sey dem dey useless.
- Oh Baba-God, blessings for di man wey you dey correct, and di man wey you dey teach your word,
- so dat you go cool am down from days of wahala, until evil pipo enta grave.
- Baba-God no go fashi hin pipo, he no go ever leave di pipo wey belong to am.
- Judgement go dey based-on justice
again, and all pipo wey get clean-heart go follow am. - Who go stand up to epp me fight evil
pipo? Who go stand, con change-am-for badbelle pipo for me? - If to sey no be Baba-God wey con epp
me—I for don settle inside silence. - If I tok sey, “My leg dey dror-fall,” chai
Baba-God, na your mercy dey carry me up. - Wen wahala burku for my mind, na you cool my soul wit happiness.
- Abi corrupt govment wey dey make
wayo law—fit be your padi? - Dem gada togeda against di life of pesin wey get clean-heart, con condemn innocent blood.
- But Baba-God na my defender, and namy God—di rock wey I dey hide my head put.
- He don repay dem for dia sins, and he go cut dem komot inside dia wickedness; Yes, Baba-God awa Oga go cut dem komot.