Psalm Chapter 95
Praise Plus Worship
- Come make we sing to Baba-God, make we raise awa happy voice to di rock of awa salvation.
- Make we come hin front wit tanks-giving, con shout wit happiness to am wit
- Na Baba-God be di ogbonge God, and na di ogbonge Oba wey get levels pass oda gods.
- Di deepest part of di earth, plus di
highest part of di mountain dey for hin hand. - Nahin get di big-rivers, nahin make am, and hin hand make di dry land.
- Oh come, make we bow down con
worship, make we kneel down for di Oga wey make us. - Nahin be awa God, and we be di pipo of hin green-land, we be pipo wey he dey care for—If you hear hin voice today.
- Make you no do gragra for your
mind—as una do wen una disobey me, as una do for di days of temptation for inside di desert, - wen una ancestors test me, and dem try me—even wen dem don see wetin I do.
- I vex for dat generation for forty years; I tok sey, ‘Dem be pipo wey dia heart don waka miss-road, and dem no sabi my ways.”
- So I use vex swear sey, “Dem no go enta inside my rest.”