Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 96

Abeg click here to share dis post

Baba-God Na Di Real King

  1. Oh sing new song for Baba-God; sing for God, all di whole earth.
  2. Sing for Baba-God, hail hin name; tok
    about di good news of hin salvation—day by day.
  3. Tok about hin levels for front of di
    nations, con tok about hin ogbonge works among di nations.
  4. Baba-God big well-well, and he get
    levels to receive all awa praise; dem suppose fear am pass all di gods.
  5. All di gods of di nations na idols, but na Baba-God make di heavens. Respect and majesty dey for hin hand.
  6. Strength plus beauty dey for hin holy-place.
  7. Give Baba-God, oh families of di nations, give Baba-God levels plus pawa.
  8. Give Baba-God di level wey fit hin name; bring offering and make una come hin house.
  9. Oh worship Baba-God inside di beauty of hin holiness; make all di earth shake for hin front.
  10. Tok among di nations sey, “Baba-God dey on-board.” Di world stand gidigbam, e no-fit move; he go judge di pipo wit hin church-mind.
  11. Make di heavens celebrate, and make di earth jolly; make di big-river shout, plus everitin wey dey inside am;
  12. Make di land jubilate, plus everitin wey dey inside. Naso all di trees wey dey inside forest go happy for Baba-God front.
  13. Becos he dey come, and he dey come judge di earth. He go judge di world wit [justice] goodness, and he go judge di pipo wit hin truth.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website