Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 120

Abeg click here to share dis post

Prayer For Freedom

  1. Dis na song of rising. I call on Baba-God for inside my palava, and he hear me.
  2. Oh Baba-God, save me from pipo wey
    dey tok lie, and save me from wayo tongue.
  3. Chai wayo mouth, wetin you go receive, or wetin Baba-God go do you?
  4. Sharp arrow of warrior, plus coals of
    broom tree!
  5. Kasala for me, if I stay for Mesech, sey I dey live among di tents of Kedar!
  6. E don too tey wey I dey stay wit pipo wey no like peace.
  7. I be man of peace; but wen I tok, dem
    wan fight me.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website