Psalm Chapter 136
He Dey Sorry-for Pesin Forever
- Give tanks to Baba-God becos he dey
good, and he dey sorry-for pesin forever. - Give tanks to di God of gods—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to di Oga of Oga—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God, na only am fit do ogbonge tins—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey make di heavens wit hin sense—he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey make di earth on top of water—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey make ogbonge lights—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Di sun go rule di day—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Di moon plus di stars go rule di night—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey kill Egypt first born—becos he dey sorry-for pesin forever.
- He con carry Israel komot from among dem—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Wit hin strong hand, and hand wey he stretch out—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey divide di Red sea—becos he dey sorry-for pesin forever,
- but he carry Israel pass tru di middle of am —becos he dey sorry-for pesin forever,
- and he sweep Pharaoh plus hin army inside di Red sea—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey carry hin pipo pass tru desert—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Give tanks to Baba-God wey nack great kings for ground—becos he dey sorry-for pesin forever.
- He kill ogbonge kings—becos he dey sorry-for pesin forever.
- Sihon wey be di king of Amorite—becos he dey sorry-for pesin forever.
- And Og wey be di king of Bashan—becos he dey sorry-for pesin forever,
- con give dia land to hin own pipo—becos he dey sorry-for pesin forever.
- He give di land to hin pipo Israel—di pipo wey dey serve am, becos he dey sorry-for pesin forever.
- He no dey fashi us for awa low level—becos he dey sorry-for pesin forever.
- He free us from awa enemies—becos he dey sorry-for pesin forever.
- He dey give food to everi living
tin—becos he dey sorry-for pesin forever. - Give tanks to Baba-God of heaven—becos he dey sorry-for pesin
forever.