Philemon

Philemon Chapter 1

Abeg click here to share dis post

1. Dis letterna from Paul wey be prisoner—becos he preach di good news about Christ Jesus, and from awa bros, Timothy. We dey write di letter to Philemon wey be awa correct padi and fellow hustler, 2. and to awa sista wey we love, Apphia. And to Archippus—awa fellow soja, and to di church wey dey meet for your house: 3. Grace to you, and peace from Baba-God awa Fada, and Oga Jesus Christ. Tanks-giving Plus Prayer 4. I dey tank Baba-God as I dey always call your name for my prayers, 5. I dey hear about your love and faith wey you get for Oga Jesus, and your love for all God- pipo, 6. As una dey share una faith wit odas, I pray sey make una sabi all di blessings wey Christ Jesus don give us. 7. My broda, your love don give me serious happiness and moral, and your kindness don ginger di heart of God- pipo. Paul Dey Beg ForOnesimus 8. So, even though I fit use full-mind to dey command you to do wetin you suppose do, 9. but I dey beg you based- on love, me, Paul—wey be old man, and now I be prisoner of Christ Jesus, 10. I dey beg you becos of my pikin Onesimus, wey turn to my pikin as I dey prison. 11. Before-before he dey useless to you, but now he don dey useful both to you and me. 12. I dey send am back to you. Welcome am—nahin be my heart. 13. I for like make he dey wit me—so dat he go fit take your place to dey epp me as dem chain me becos of di good news. 14. But I no wan do anytin wey you no know about, so dat any favour wey you go do—go come from your free mind, and no be like sey dem use gra-gra for you. 15. Maybe di reason why he komot from your side small, na becos he go come meet you back forever. 16. No be like slave to you again, but he pass slave. Na correct broda especially to me, but now—to una wella; both fisikally and inside Christ. 17. So if you take me as your padi, welcome am as you go welcome me. 18. If he do any wrong tin to you or owe you anytin, put am for my head—I go pay. 19. Me—Paul, I dey write dis tins wit my own hand. I go pay back. But no forget sey you owe me even yoursef. 20. Yes broda, make I get happiness from you inside Christ. Ginger my heart inside Christ.

21. I get full mind as I dey write dis letter, sey you go do wetin I ask you to do, and sey you go even do pass wetin I tok.

22. But arrange one room for me, becos I believe sey tru your prayers, I go come meet you.

23. Epaphras, my fellow prisoner in Christ Jesus—dey send you hin greetings.

24. Mark, Aristarchus, Demas, plus Luke my fellow worker—dey send dia greetings sef.

25. Make di grace of Oga Jesus Christ dey wit your spirit. Amem.

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Recommended
Do Beta Tin 1. No forget to tell di pipo…
Cresta Posts Box by CP
No copy from dis website