2nd Corinthians

  • 2nd Corinthians

    2nd Corinthians Chapter 1

    Paul Throway Salute 1. Dis letter na from Paul wey be apostle of Jesus Christ—by di will of Baba-God, and from awa broda Timothy. I dey write to di church of Baba-God wey dey for Corinth, and to all God-pipo wey dey around Achaia: 2. Make Baba-God awa Papa, plus Oga Jesus Christ—give una grace plus peace. Di God Of Everi Comfort 3. Blessings for Baba-God and Papa of awa Oga Jesus Christ, di Papa wey dey sorry-for pipo, and di God of everi comfort. 4. He dey comfort us for awa palava, so dat we sef go fit comfort those pipo wey get palava—wit di comfort wey we don…

No copy from dis website