- Oh Lord, no yari for me wen you dey vex or correct me wen you dey pkara.
- Lord sorry for me, my bone no strong; I be like paper.
- My soul dey vex no be small. How long O Lord, how long?
- Look my side chai Baba-God and make you deliver me; save my life becos your
love no dey fail.
- No pesin go remember you wen hin don die. Who fit throway-salute for you
from grave?
- I don taya to dey cry inside; throught di night I dey cry river ontop my bed and
soak my chair wit water from my eyes.
- My eyes dey pain me becos of too much cry-cry; dem dey pain me becos of my
enemies.
- Comot for my side badbelle dem, Baba-God don see hear my cry.
- Bab-God don hear my cry for mercy; God don hear my prayers.
- Shame go catch all my enemies and dem go dey disappointed; dem go turn
back and shame go catch dem kia-kia.
Post Views: 71