- Epp, Lord, pipo wey dey do good no dey again; faithful pipo don finish for dis
world.
- Everi-pesin dey lie to hin neighbor; dia sweet-mouth dey do wayo.
- Make Baba-God cut comot everi lips wey dey tok sweet-mouth and wey dey
yarn wit wayo.
- wey tok sey “We go win wit awa mouth; na we get our mouth—who be awa
Oga?
- ‘Becos of di oppression of pipo wey no get power and di cry wey poor pipo dey
cry inside dia heart, I go standup now, I go protect dem from pipo wey dey use dia
life play.’
- And di word of God no dey make mistake. Like silver wey dem process for faya
of clay, wey dem purify seven times.
- Oh Lord, you go keep us safe, you go protect us from those kain pipo forever.
- Wicked pipo dey korokoro dey denge-pose wen men no fit condemn bad tin.
Post Views: 66