Psalm Chapter 14
- Pipo wey no get sense tok sey “Baba-God no dey.” Dem be bad eggs, dia ways
wicked die; no-pesin dey wey dey do good. - Baba-God look down from heaven to see if pesin still dey wey overstand among
man pikin dem, if pesin still dey wey dey fyne God. - Everi-pesin dey live dia life, all dia eyes don tear reach ground; nobody dey do
good again, no single pesin. - Badbelle pipo no go ever learn—those pipo wey dey chop my pikin as men take
dey chop bread, and wey no dey call Baba-God name? - See dem as dem, as fear don cover dia head, Baba-God dey for where good
pipo dey. - una wey be wicked pipo dey spoil poor pipo plans, but na Baba-God go hide
dem. - Oh make salvation for Israel come from Zion! Wen Baba-God go bring back di
wealth of hin pipo, make hin pikin dem jirate and jubilate.
Questions about Psalm 14
What is Psalm 14 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 14 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-14/
Where can I read Psalm 14 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 14 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-14/
Which Bible book contains Psalm 14?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 14?
The chapter identified by this reference is 14.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Fear
- Money