Psalm Chapter 20

Abeg share
  1. Make Baba-God hear you wen wahala show face; make di name of di God of
    Jacob protect you.
  2. Make he send you epp from hin holy-place, con give you support from Zion.
  3. Make he remember all your scrifce con accept all your burnt offering.
  4. Make he give you di tins wey you really want from your heart and make all your
    plans succeed.
  5. We go shout wit happiness wen you succeed, con carry awa banner go up in di
    name of awa God. Make Baba-God give you everitin wey you dey ask am.
  6. Now I know sey Baba-God dey save pipo wey he anoint; he dey ansa am from
    hin holy heaven wit di power of hin right hand to save.
  7. Some pipo trust in chariot, and some dey trust in horses, but we go remember
    di name of awa God.
  8. Baba-God bring dem down to dia knees and dem fall, but we go rise up stand
    gidigbam.
  9. Oh Lord, save di king! Ansa us wen we call.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *