- Oh Baba-God, di King dey happy for your strength. He dey happy well-well
becos you don give am plenty winning!
- You don give am wetin he really want and you give am everitin wey hin ask you.
- You welcome am wit rich blessings, you put crown of pure Gold for hin head.
- He ask you for life and you give am—long life forever and ever.
- He glory great becos of di winning wey you give am; you don use beauty and
might take cover am
- You don give am everlasting blesings wey sure con make hin boy sweet am
becos hin know sey you dey by hin side.
- Even di oba dey trust Baba-God. No shaking for di king becos of Baba-God love
wey no dey fail am.
- You go use your hand catch all your enemies; your right hand go gbab your
enemies.
- Wen you go show, you go lick dem like a faya wey hot die. God go swallow dem
as he dey pkara and he fire go burn dem.
- You go scata dia descendant from di earth, you go comot dia pikin-pikin-pikin
wey dem neva born from di earth.
- Dem plan bad tin for you, dem even set trap for you, dem no go fit succeed;
- you go make dem turn dia back wen you shoot dem wit your bow and arrow.
- you get levels, Oh Lord, wit your strength we go sing and praise you power.
Post Views: 45