Psalm Chapter 22

Abeg share
  1. Baba-God, Baba-God, why you con fashi me liked dis? Why you dey very far to
    save me, you far well-well from di cry wey I dey cry for my heart?
  2. Oh my God, I dey cry for day time but you no ansa me, for night, I no stop to
    dey cry.
  3. But you sidon for throne as di Holy one; na you be the praise of Israel.
  4. Na inside you our papa-papa-papa put trust; dem trust you and you save dem.
  5. Dem cry to you and you save dem; na you dem trust and you no dey disappoint
    dem.
  6. But I be worm and I no be man, pipo dey laff me and my pipo dey fashi me.
  7. All those pipo see me dey yab me; dem sama me wit insult con dey shake dia
    head;
  8. “He trust in Baba-God; make God save am. Make God deliver am, since he like
    God well-well.
  9. But you comot me from inside belle; you make me trut you even wen I dey suck
    my malee breast.
  10. From wen dem born me nahin I dey wit you; na you be my God from inside my
    mama belle.
  11. No dey far from me, yawa wan gas and I no get pesin wey go epp me.
  12. Plenty nama surround me; strong malu of Bashan don round me.
  13. Lion wey dey shout dey kill bush-meat open dia mouth wide for me.
  14. I be like water wey pour and all my bones don comot for my joints. My heart
    don turn to wax; e don melt throway inside me.
  15. My energy don dry like clay, and my tongue don gum ontop of my mouth; you
    make me lie down for dust of death.
  16. Dogs don gather round me; group of badbelle pipo don gather round me, dem
    don shuuk my hand and my leg.
  17. I fit count all my bones; pipo dey look me dey laff.
  18. Dem share my cloths con cast lot to share my cloth.
  19. But Baba-God, make you no dey far from me. Chai my strength, come epp me
    kiakia.
  20. Save my life from sword, save my precious life from di power of di dogs.
  21. Save me from di mouth of di lions; save me from di wild oxen horn.
    22.I go yarn my brodas about your name; I go praise you for where your pikin
    gather.
  22. Praise Baba-God you wey dey fear am! All di descendant of Jacob, make una
    honour am! Respect am all una descendants of Israel!
  23. He neva bone or fashi una wey dey suffer; he never hide hin face from am but
    he don hear una hin cry for epp.
  24. Na from you I dey get my inspiration for my praises where your pikin gather; I
    go fufil my vow for front of pipo wey dey fear you.
  25. Poor man go chop belleful; pipo wey dey fyne Baba-God go praise am—make
    una heart live forever.
  26. Everi-pesin wey dey di world go remember con follow God way and all di
    families of di Nations go knee down for front of Baba-God,
  27. na Baba-God get control, nahin dey rule di nations.
  28. All di rich pipo for di earth go throway party to worship Baba-God, and pipo
    wey go down to dust sef go knee down for Baba-God—those pipo wey no fit keep
    demsef alive
  29. Our pikin-pikin-pikin go serve Baba-God. Dem go yarn future Generations
    about Baba-God.
  30. Dem go yarn about hin righteousness, even di pikin wey dem never born now
    go tok about God—God don do am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *