- Na Baba-God get di earth plus everitin wey full inside am;
- He create di earth upon of water and na ontop of water na hin stand di earth
gidigbam.
- Who fit climb ontop of Bab-God hill? Who fit stand for hin holy place?
- Na pesin wey get clean hand and pure heart, pesin wey no dey worship idol, or
use wetin no dey true take swear.
- He go receive Baba-God blessing and Baba-God go make am dey right.
- Naso Baba-God go bless di generations of pipo wey fyne God face.
- Raise your head up, Oh you gates, lift up, you olden days door, so dat di King of
glory go waka enter.
- Who be dis king of Glory? Di Lord wey dey strong an powerful, Baba-God wey
strong for fight.
- Raise your head up, Oh you gates; lift dem up, you old school door, so dat di
King of glory go fit waka enter.
- Who be dis king of glory? Baba-God wey dey mighy—nahin be the king of
glory.
Post Views: 68