Psalm Chapter 24
- Na Baba-God get di earth plus everitin wey full inside am;
- He create di earth upon of water and na ontop of water na hin stand di earth
gidigbam. - Who fit climb ontop of Bab-God hill? Who fit stand for hin holy place?
- Na pesin wey get clean hand and pure heart, pesin wey no dey worship idol, or
use wetin no dey true take swear. - He go receive Baba-God blessing and Baba-God go make am dey right.
- Naso Baba-God go bless di generations of pipo wey fyne God face.
- Raise your head up, Oh you gates, lift up, you olden days door, so dat di King of
glory go waka enter. - Who be dis king of Glory? Di Lord wey dey strong an powerful, Baba-God wey
strong for fight. - Raise your head up, Oh you gates; lift dem up, you old school door, so dat di
King of glory go fit waka enter. - Who be dis king of glory? Baba-God wey dey mighy—nahin be the king of
glory.
Questions about Psalm 24
What is Psalm 24 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 24 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-24/
Where can I read Psalm 24 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 24 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-24/
Which Bible book contains Psalm 24?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 24?
The chapter identified by this reference is 24.
Topics connected to this passage
- Strength
- Worship