- Na you, Oh Baba-God nahin I dey I carry my soul give;
- na you I trust O Baba-God. No let pipo laff me, no let badbelle pipo win me.
- Shame no go catch any pesin wey put he hope inside you. But shame go catch
all those pipo wey dey do evil tins wfor no reason.
- Show me your ways, Oh Baba-God, teach me your road;
- guide me inside your truth and make you teach me, na you be my God wey
save me, and my hope dey inside you everyday.
- Remember, Oh Baba-God, E don tey wey your great mercy and love dey for me.
- Make you forget those bad-bad tings wey I do wen I be small pikin and my
disobedient ways; remember me wit your plenty love, you too good, Oh Babagod.
- Baba-God dey good and hin way straight; he dey teach sinners for hin road.
- He dey guide pipo wey dey live jeje life for wetin dey right and dey teach dem
he ways.
- All Baba-God way dey full wit love and faithfulness to those pipo wey do wetin
he agreement tok.
- Forgive my sins even though dem big, becos of you name Baba-God.
- Who con be di man wey dey fear Baba-God? God go teach am di way wey he
choose for am.
- He go live in prosperity and hin pikin-pikin go inherit di land.
- Baba-God dey code tins wit pipo wey dey fear am; he dey let dem know hin
convenant.
- My eyes always dey look Baba-God, na only am fit remove my leg from trap.
- Look my side and make you show me love wey I no expect, I dey alone and I
dey suffer.
- Di wahala wey dey my head too burku; free my from palava.
- Look my yawa plus kasala, con remove my sisn.
- See as my enemies don burku and see as dem take hate me die!
- Guard my life and make you save me; make shame no catch me, na your body
I dey hide my head put.
- Make my good-name and straight way protet me, becos my hope dey wit you.
- Save Israel, Oh Baba-God from all dia kasala!
Post Views: 51