Psalm Chapter 27
- Na Baba-God be my light and salvation, who I go com dey fear? Na God be the
Ogidiga of my life—notingo fit make me fear! Baba-God na di strong-house of my
life—who I go con dey fear - Wen evil men wan change am for me, to chop my flesh, wen my enemies and
badbelle pipo attack me, dem go fall yakata for ground. - Even though army dey for my front and back, my mind no go cut; even if dem
start war against me, na dat time I go com bigup my chest for dem. - One tin wey I dey ask from you Baba-God, dis na wetin I dey fine: sey make I
dey inside your house forever, make I fit look di beauty of God and to fine am
inside hin temple. - He go keep me safe inside hin house wen di day of wahala show; he go hide me
under di roof of hin holy temple, con carry me high ontop rock. - Naso he go carry my head high pass di enemies wey dey around me; for inside
hin house I go sacrifice as I go dey shout wit joy; I go sing and compose music for
Baba-God. - Hear my voice wen I call you Baba-God; sorry for me con ansa me.
- My heart dey yarn you sey, “Fyne hin face. Na your face dey fyne so Oh Baba-
God.” - No hide your face from me, no throway face from your servant becos you dey
vex for am; e don tey wey you don dey epp me. No fashi me or bone me, Oh
Baba-God my Savior. - Even if my malee and palee fashi me, Baba-God go accept me.
- Teach me you ways Baba-God, lead me inside you straight road becos of di
pipo wey dey oppress. - No let bad tin wey badbelle pipo want make e happun to me—happun to me.
Pipo wey dey lie for my head don standup against me. Dem want fight me. - I still dey bigup my chest sey: I go see Baba-God goodness for dis life.
- Wait for Baba-God, make you dey strong con get mind, con wait for Baba-God.
Questions about Psalm 27
What is Psalm 27 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 27 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-27/
Where can I read Psalm 27 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 27 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-27/
Which Bible book contains Psalm 27?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 27?
The chapter identified by this reference is 27.
Topics connected to this passage
- Hope
- Prayer
- Salvation
- Fear
- Strength
- Worship