- Na you I dey call Oh Baba-God my rock. No dey close your ears for me. If you no
gree follow me yarn, I go be like those pipo wey don go down six feet.
- Hear my cry for mercy as I dey call you make you epp me. As I raise my hand up
dey face your Most Holy Place.
- No drag me comot wit badbelle pipo, wit those pipo wey dey do evil, wey dey
follow dia neighbor tok well but dey carry bad tin for mind.
- Repay dem for dia evil handwork, repay dem wit wetin dem don do wit dia
hand, con give dem wetin dem deserve.
- As dem no gree show respect for Baba-God handwork, Baba-God go tear dem
down and he no go build dem up again.
- Praise be to Baba-God becos he don hear my cry for mercy
- Na Baba-God be my strength and my guard; my heart trust am and he con epp
me. My heart dey jump wit joy and I go sing song take tank am.
- Na Baba-God be di streanght of hin pipo, na strong-house wey dey save hin
pipo wey he anoint.
- Save your pipo and bless your inheritance; make you be their Shepard wey go
carry dem forever.
Post Views: 42