- Blessed be na man wey Baba-God don already forgive hin sin, wey hin sins dey
covered.
- Blessed na the man wey Baba-God no dey use hin sisn take judge am and wey
hin spirit no dey do wayo.
- Wen I quiet, my bones come taya becos of di cry wey my heart dey cry
everiday.
- For day and for night, your hand heavy for my body; my energy con waka like
heat for hot weather.
- Naso I con gree sey I don sin and I no hide di bad tins wey I dey do from you. I
con sey, “I go confess my sins to Baba-God”—and you forgive di shame of sin.
- So make everi-pesin wey love Baba-God pray to you wen you dey near; wen
flood go come, dem to no fit reach where hin dey.
- Na inisde you I dey hide my head; na you go protect me from kasala and
surround me wit songs of deliverance.
- I go school you con teach you dey way wey you suppose follow; I go advice you
and I go watch you.
- Make you no be like horse or mule, wey no sabi anytin, wey dem must control
wit bit and bridle or dem no go come meet you.
- Badbelle pipo get plenty wahala but Baba-God love wey no dey fail nahin
surround those pipo wey trush in name.
- Make you happy for Baba-God and make you dey glad, righteous pipo; make
una sing, and all those wey get clean heart.
Post Views: 45