- Oh Baba-God, no yari for me me wen you dey pkara or correct me wen you dey
vex.
- Your arrows don shuuk me, and your hand don press me down.
- I no well becos you dey vex for me; my bone dey weak becos of my sins.
- The bad tins wey I do dey pinch my mind, like load wey too heavy for me to
carry.
- My wound dey bad more-more and e dey irritate me.
- I don bow down and my level don over low; I dey cry everi day.
- My back full wit serious pain; my health dey very poor.
- I no get power and I even don dey give up; I dey cry inside my heart wit pain.
- You know everitin wey I want, Oh Baba-God; I no dey hide even my hiss from
you.
- My mind dey do gbim-gbim, strenght no dey again; even di light don comot
from my eyes.
- My padi and pipo dey fashi me becos of my wound; my neighbors dey run
from me.
- Pipo wey want dey fyne my life dey set trap for me, those pipo wey wan
wound me dey yarn as dem go take fall my hand; everiday dem they plan dia
mago-mago.
- I be like deaf man wey no dey hear word; like sey dem cut my tongue comot,
and I no fit open my mouth;
- I don trun to man wey no fit hear, wey to fit use hin mouth ansa pesin.
- I dey wait for you, O Baba-God, you go ansa me, Oh Baba-God.
- Naso I sey, “Make you no let dem laff me or make-mouth wen I dror-fall.”
- I go soon fall and my pain always dey my body.
- I confess my bad-bad-sins; my sins dey give me wahala.
- My serious enemies plenty, those pipo wey hate for no reason burku.
- Those pipo wey dey pay my good wit evil, dey tok bad tins for my back wen I
try to progress.
- O Baba-God, no fashi me; no dey far from me Oh Baba-God.
- Pkapkapka come epp me, Oh my savior.
Post Views: 35