Psalm Chapter 39
- I sey, “I go watch my ways con keep my tongue from sin; I go close mouth any
time wey badbelle pipo dey around me” - But wen I dey silent and calm, and I no even yarn anytin good, my suffer-suffer
con burku. - My heart don dey hot for my chest, and as I dey meditate, e be like sey the faya
dey burn more-more, I con tok wit my tongue: - “Kukuma show me where my life go for end and how many more days I get for
dis earth, make I know as my life take be like breeze. - You don make my days just like handbreath; di time wey I get for dis life na
nothing for you. Everi man life jut be like one single breath. - As man dey waka upandan, hin life just be like sometin wey no dey exist for
where you dey. He just dey waste hin time dey denge-pose all about.
7.“But now Baba-God, wetin I dey fyne? My hope dey for you. - Save me from all my big-big sins; no make mumu pipo dey laff me.
- I bin dey silent; I no gree open my mouth, na you do am.
- Carry your koboko comot from my side. The blow wey you give me don nack
me down. - You yari for men con correct men becos of dia sins; you vanish dia wealth like
moth—everi man be like breath. - “Hear my prayers Baba-God; make you hear my cry for epp, no close ears for
my cry. I dey your house like foreigner, like Jjc for as my papa-papa be. - Carry your eyes comot from my body, so dat body go sweet before I comot
and I no go dey again.”
Questions about Psalm 39
What is Psalm 39 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 39 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-39/
Where can I read Psalm 39 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 39 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-39/
Which Bible book contains Psalm 39?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 39?
The chapter identified by this reference is 39.
Topics connected to this passage
- Hope
- Salvation
- Forgiveness
- Money