- Prove sey I dey right, Og Baba-God, and make you fight for my mata against
nation wey no dey fear God; save me from wicked men and men wey dey do
mago-mago.
- Na you be my God and my strong-house. Why you con fashi me? Why must I
dey cry upandan as my enemies don use me do anyhow?
- Send you light and truth, make dem guide me; make dem carry me go di holy
mountain for where you dey stay.
- Na den I go con go di altar of God, go meet Baba-God wey dey make my belle
sweet me. I go praise you wit harp, Oh God, my God.
- Why you put yourself for ground O my soul? Why na so-so wahala full your
spirit? Put your hope on Baba-God, I go still dey praise am, my saviour and God.
Post Views: 43