- Na Baba-God we dey hide awa head put and nahin be awa strength, he always
dey to epp us wen yawa gas.
- So fear no go catch us even if di earth dey shake and di mountain fall inside di
sea,
- even though di water dey make noise and dey foam, and di mountain dey
shake anyhow as e dey burs-out.
- One river dey wey di water dey make Baba-God city jolly, di high place where di
most high dey stay.
- Baba-God dey stay around her, she no go fall, God go epp her before morning
reach.
- Nations dey pkara, kingdoms dey fall; di earth dey melt wen he raise hin voice.
- God almighty dey wit us; na God of Jacob be awa strong-house.
- Make una come see Baba-God works, di dsuffer-head wey he don bring come
di earth.
- He stop all di war wey dey di earth; he break all di bows con scata all di spear,
he use faya burn di shield.
- “Make you relax and know sey na me be Baba-God; my level go high for
where di nations dey, my level go high for di earth.”
- Baba-God almighty dey wit us. Na God of Jacob be awa strong-house.
Post Views: 44