Psalm Chapter 48

Abeg share
  1. Baba-God great and he get levels to recieve awa praise, for inside di city of awa
    God, for hin holy mountain.
  2. E fine well-well no be for mouth, body dey sweet di whole earth. Like di up-up-
    up of Zaphon naso mount Zion be, di city of di ogbonge king.
  3. Baba-God dey inside her strong-house; he don show hinsef to be her strong-
    house.
  4. Wen di king put-hand-together, wen dem carry-go together,
  5. dem see her con surprise, dem gbess wit gbege for dia head.
  6. Dem dey shake for where dem dey, dem dey feel pain like woman wey wan
    born pikin.
  7. You scata dem like ship to Tarshish wey di east breeze blow scata throway.
  8. As we don hear, naso we don see for di city God almighty city, for inside di city
    of awa God: Baba-God don make her dey secure forever.
  9. For inside you temple, Oh Baba-God, we go dey meditate on your love wey no
    dey fail.
  10. Like your name, naso your praises dey reach di end of di earth; your right
    hand full wit righteousness.
  11. Mount Zion dey jolly, di villages wey for inside Judea dey happy becos of your
    judgement.
  12. Waka upandan for inside Zion, count her tall buildings,
  13. reason her wall, look her strong-houses, so dat una go fit tell di next
    generation about dem.
  14. Dis God na awa God for ever and ever; he go be our guide reach di end.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *