Psalm Chapter 49

Abeg share
  1. Make una hear this one, all di pipo; listen, everi-pesin wey dey stay inside dis
    world,
  2. both big and small, rich and poor:
  3. My mouth go yarn words of wisdom; wetin my heart dey yarn go make pipo
    understand.
  4. I to put my ears down for proverb; wit harp I go explain my riddles;
  5. Why I go dey fear becos evil days dey come, wen wicked wayo pipo gather
    me—
  6. Those pipo wey put dia trust for inside dia moni and wey dey make-mouth wit
    dia plenty moni.
  7. No-pesin fit save anoda pesin life or pay Baba-God moni for hin life—
  8. you no fit buy pesin life, your moni no fit reach—
  9. so dat you go live forever and make your body no rotten.
  10. Everi-pesin don see sey even wise men dey die; mumu and dondi sef dey die
    con leave dia moni for anoda pesin.
  11. Dia grave nahin go be dia house forever and na for there dem go stay for
    many generations, even if dem name full street wit dia name.
  12. But man, even wit hin riches, he no dey last, he be like animal wey dey pkeme.
  13. Na wetin go happun to those pipo wey put dia trust for demsef and dia
    followers wey believe wetin dem yarn.
  14. Like sheep, na so dem go go six feet, and death go chop dem. Pipo wey dey
    waka straight go rule dem for morning; dem go rotten for inside grave; far-far
    from dia royal manshion.
  15. But Baba-God go save my life from grave; he go surely carry me go where he
    dey.
  16. No over reason am if pesin start to dey make plenty moni, wen di beta-beta
    tin wey hin house start to dey burku.
  17. He no go fit carry anytin follow body wen he die, hin fine-fine-tins no go follow
    am enta grave.
  18. Even though he count hinsef as pesin wey dey blessed wen he dey alive—and
    men go praise you wen you dey make am—
  19. he go join di generations of hin papa dem, wey no go fit ever see di light of
    life.
  20. Man wey get riches but no get understanding be like animal wey go die.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *