- Wit your name, save me, Oh Baba-God; prove sey I dey right me with you big
power.
- Hear my prayer, Oh Baba-God, listen to di lyrics of my mouth.
- Jjc dey attack me; men wey wicked well-well wan take my life—men no dey
fear God.
- Na Baba-God surely be my epp; na Baba-God dey keep me.
- Make evil tie round pipo wey dey bad-mouth me, scata dem wit your
faithfulness.
- I go give you offering sacrifice wit my free mind; I go cut-cap your name, Oh
Baba-God becos your name good.
- He don free me from all my palava, and my eyes don look badbelle pipo wit
victory.
Post Views: 33