- Hear me, Oh Baba-God, as I dey voice my complain; protect my life from enemy
threat.
- Hide me from di bad coded tin wey wicked don plan for me, from noise of di
plenty evil pipo.
- Dem dey sharp dia tongue like sword and dem dey throw yarning like sharp
arrow.
- Before innocent man know dem don shoot; dem no even fear, dem just shoot
am like dat.
- Dem they support dia sef for dia bad plan, dem dey tok as dem go take hide dia
trap; dem sey, “Who go dem?”
- Dem plan ojoro dem con sey, “We don get beta plan!” True-true, man mind
and heart too get wayo.
- But Baba-God go shoot dem like arrorws; now-now-now Baba-God go nack
dem down.
- He go use dia mouth put dem for wahala con scata dem finish; everi-pesin wey
see dem go laff shake head.
- Fear go catch everi man, dem go tok about Baba-God handwork con eaon wetin
hin don do.
- Make the righteous pipo happy for Baba-God, and make dem hide dia head
for Baba-God body; make everi-pesin wey get clean mind praise am!
Post Views: 48