Psalm Chapter 72

Abeg share
  1. Make justice brekete for di king hand, Oh Baba-God, di royal pikin wit your
    righteousness.
  1. He go judge your pipo wit righteousness, and he go judge your pipo wey dey
    suffer wit justice.
  2. Di mountain go bring prosperity for di people, di hills go bring di fruit of
    righteousness.
  3. He go defend di pipo wey dey suffer among una con save pipo wey no get shi-
    sh—dia pikin. He go match oppressor for ground.
  4. He go dey as long as the sun dey, as the moon dey tru all generations.
  5. He go be like rain wey dey fall for farm wey dem don clear, like rain wey dey
    water di earth.
  6. Wen time reach, righteous man go blow, plenty-plenty go dey till di moon fade.
  7. He go rule from seas to sea and from river to river reach where di earth for end.
  8. Di tribes for inside di desert go bow down for hin front am, and he enemies go
    lick dust.
  9. Di king of Tashish and kings from abroad go con page homage; the kings of
    Sheba and Seba go carry gift con meet am.
  10. All kings go dobale for am and all nations go serve am.
  11. He go free pipo wey no get shi-shi wey dey cry out, and pipo wey dey suffer-
    suffer—wey no get pesin to epp dem.
  12. He go sorry for pipo wey no get power and pipo wey no get shi-shi, con save
    pipo wey no get shi-shi from death.
  13. He go save dem from oppression and pipo wey dey fight dem, dia blood dey
    precious for hin eyes.
  14. He go live long! Dem go give am gold from Sheba. Make pipo always dey pray
    for am, con dey bless am from morning to night.
  15. Make food yanfu-yanfu for di land; make e swing ontop of hill. Make hin fruit
    yapka like Lebanon; make e grow like grass for field.
  16. Make he name dey forever; make e continue as long as di sun dey shine. All
    nations go dey blessed wit am and dem go call am blessed.
  17. Praise be to di Lord God, the God of Israel, wey na only am fit do elele tins.
  18. Praise be to hin glorious name forever; make di whole earth full wit hin glory
    Amen and Amen.
  19. Naso David, wey Jesse pikin take finish hin prayers.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *