Psalm Chapter 90
Baba-God Dey Forever
- Dis na prayer of Moses wey be Baba-God man. Baba-God, e don tey wey you be awa
house, for all generations. - Before you make di mountains, or even before you make di earth, plus di world, and
even from everlasting to everlasting na you be Baba-God. - You dey turn men back to dust, and you dey tok sey, “Oh man pikin, go back to dust,”
- One thousand years for your eyes—just be like yesterday wen e pass, or like four hours
for night. - You sweep dem komot like plenty-water; dem be like sleep. For morning, dem be like
grass wey dey grow. - E dey grow for morning and e dey shine, but befor e evening—dem don cut am down,
and e go dry finish. - We dey kpeme as you dey para, and we dey shake as you dey vex.
- You don put awa sins for your front, awa coded sins dey for di light wey dey shine for
your front. - All awa days dey waka go as you dey vex for us, and we dey spend awa life like tori
wey dem dey gist. - Awa life no pass seventy years—if we get pawa reach—eighty; on top of dat, na only hustle, plus wahala pipo fit use make mouth. Awa days go pass sharp-sharp, and we go fly komot.
- Who sabi di pawa of your vex? Your vex big like di fear wey pipo get for you.
- Teach us how to count awa days, so dat awa heart go sabi wisdom.
- Oh Baba-God, come back to us! How long? And show your servant your soft
heart. - Make us belleful early wit your mercy, so dat we go fit celebrate, and dey happy all awa
life! - Make us jolly reach di numbas of days wey you don punish us, replace di evil days
wit good times. - Make your work show-face to your servant, and make your glory dey on dia
pikin. - Make di beauty of Baba-God awa Oga—dey upon us, and make awa business
stand—yes, make awa business stand
Questions about Psalm 90
What is Psalm 90 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 90 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-90/
Where can I read Psalm 90 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 90 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-90/
Which Bible book contains Psalm 90?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 90?
The chapter identified by this reference is 90.
Topics connected to this passage
- Prayer
- Wisdom
- Fear