Psalm Chapter 97
- Di Lord dey reign, make di earth dey happy; make di water wey dey far-far dey
rejoice. - Cloud plus heavy darkness dey around am; righteousness plus justice na di
foundation of hin throne. - Faya dey burn for hin front wey dey lick hin enemies wey dey all hin side.
- Na hin lightening dey light up di world; di earth see am con fear-fear.
- Di mountains dey melt like candle water for Baba-God front, for front of di Oga
pkata-pkata of all di earth. - Di heavens dey yarn about hin righeousness and all di pipo dey see hin levels.
- Shame don dey catch all di pipo wey dey worship image—those wey dey make-
mouth wit dia idols—make una worship am all di gods! - Zion hear dey rejoice plus di villages wey dey Judah dey happy becos of your
judgement, Oh Baba-God. - Na you, Oh Baba-God, be di Most High for di whole earth; you get levels pass all
di gods. - Make all those pipo wey love Baba-God hate evil, he dey guard di lives of hin
faithful pikin, con comot dem from wicked pipo hand. - Light dey shine for righteous pipo head and joy dey for di head of pipo wey get
clean heart. - Rejoice for Baba-God, all of una wey dey righteous and praise hin holy name.
Questions about Psalm 97
What is Psalm 97 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 97 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-97/
Where can I read Psalm 97 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 97 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-97/
Which Bible book contains Psalm 97?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 97?
The chapter identified by this reference is 97.
Topics connected to this passage
- Love
- Fear
- Worship