Psalm Chapter 100
Dis Na Hymn Of Praise
1. Dis na Psalm of tanks-giving. Make una shout wit happiness to Baba-God, all di earth.
2. Make una jolly dey serve Baba-God; carry songs of happiness come meet am.
3. Make una know sey Baba-God na Oga. Nahin make us, and no be we make awasef. We be hin pipo—di sheep of hin farm.
4. Enta hin gate wit tanks-giving and hin house wit praises; give tanks to Baba-God con bless hin name.
5. Baba-God dey good, and he dey sorry-for pesin forever; and hin truth dey last for all generations.
Questions about Psalm 100
What is Psalm 100 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 100 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-100/
Where can I read Psalm 100 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 100 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-100/
Which Bible book contains Psalm 100?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 100?
The chapter identified by this reference is 100.
Topics connected to this passage
- Worship
One Comment
Abel maiyaki
So good but is had to read