Psalm Chapter 140
Freedom From Pipo Wey Dey Show Me PepperBecos Of Baba-God
1. For di producer of music. Dis na Psalm of David. Oh Baba-God, save me from evil men; protect me from men wey like fight fight,
2. men wey dey plan evil for dia heart, and wey dey always gada togeda for war.
3. Dem sharp dia tongue like snake. Snake poison dey drop from dia lips.
4. Oh Baba-God, guard me from di hands of wicked pipo. Protect me from men wey like to shed blood, wey don dey plan to make me fall.
5. Men wey dey buga don set trap for me, plus ropes; dem don spread net for corner of road. Dem don set trap for me.
6. I con tell Baba-God sey, “Na you be my God. Hear my cry for mercy Oh Baba-God.”
7. Oh Baba-God my Oga—di pawa wey dey save me—wey dey cover my head wen fight dey.
8. Oh Baba-God, no give wicked pipo wetin dem wish for; no let dia plan succeed, or dem go dey make- mouth.
9. As for di head of those pipo wey surround me, make di evil wey dey dia mouth cover dem.
10. Make hot faya fall for dia head. Make dem throway dem inside faya, make dem fall inside deep hole—sote dem no go fit stand up again.
11. Make pipo wey get bad-mouth no stand gidigbam for di land; make evil pursue pipo wey like to shed blood—to fall dia hand.
12. I know sey Baba-God go fight for pipo wey dey suffer, and justice for poor pipo.
13. Surely good pipo go praise your name, and di pipo wey get clean-heart go stay wit you.