Proverbs Chapter 23
Listen To Your Papa
- Wen you sidon wan follow king chop,
reason wetin dey for your front, - Put knife for your throat, if you get
longatrot. - No let your eyes shuuk for hin mende-
mende food, becos he fit dey try to deceive
you. - No kill yoursef becos you wan make moni,
use your common sense take maintain. - If you put your eyes on moni, before you
know moni don waka, e go fly like eagle go
up-up. - No chop food from pesin wey get tight-
hand, no reason hin mende-mende food. - Na di kain pesin wey dey always reason
how much he don spend. He go tok sey,
“Chop and drink,” but he no mean am from
hin heart. - You go vomit di small food wey you don
chop, con waste your greeting—wey you
don greet am. - No follow ode reason, or he go laff your
wise words. - No go shift olden days boundary stone
becos you wan use ogboju collect orphan
land. - Baba-God wey dey defend dem strong
well-well; he go carry dia mata for hin head
take fight you. - Use your heart take reason wetin you don
learn, and use your ears take listen to wetin
dem dey teach you. - Correct small pikin; if you flog am wit
cane he no go kpeme. - Flog am wit cane to save hin soul from
death. - My pikin, if your heart wise, naso my
heart go dey sweet me wella. - Eehn…my deep-deep spirit go happy
wen your lips dey tok di right tins. - No let your heart dey jealous sinners, but
dey serious to respect Baba-God everi day, - Your future hope na sure-banker, and
your hope no go cut komot. - Listen my son, so dat you go wise, and
make you keep your heart for di way. - No join pipo wey dey jogodo, or join
longatrot wey dey chop meat anyhow, - shayo-master and longatrot go poor las-
las, and sleep-sleep go make dem baffup wit
dirty-cloth. - Listen to your papa wey give you life, and no fashi your mama wen she don old.
- Buy di truth, but no sell am; get wisdom,
learning, plus understanding sef. - Good man papa dey happy well-well,
and pesin wey get wise pikin dey happy for
hin pikin. - I pray for happiness for your mama and
papa; make di woman wey born you jolly! - My son, give me your heart, and make
your eyes observe my way. - Ashawo na deep hole, and to follow
olosho be like sey you fall inside tin well. - Naso she dey wait for her maga, and she
dey make plenty men dey unfaithful. - Who get yawa? Who get sorrow? Who
dey always kwanta? Which pipo dey always
complain? Which pipo get yeye wound?
Who get red eyes? - Na those pipo wey dey jogodo well-well,
pipo wey dey fyne drink wey dem don mix. - No dey look drink as e fine for eyes, as e
dey shine for cup, as e smooth for throat! - Las-las e dey bite like snake, and e dey
poison like viper. - Your eyes go see wetin you neva see
before, and your mind go dey imagine tins
wey go confuse you. - Eehn…you go be like pesin wey dey
sleep for middle of big-river, like pesin wey
sleep on top of ship pole, you go tok sey, - “Dem nack me but I no wound! Dem beat
me, but I no feel anytin! Which time I go
wake up make I collect anoda bottle?”