-
Joel Chapter 2
Army Of Locusts Open Una Heart 12. Baba-God tok sey, “Even now, make una come back to me wit una full heart, wit fasting, cry-cry, and sadness. 13. Make una tear na heart open, instead of to tear una cloth. Come back to Baba-God wey be una Oga, becos hin grace brekete and he dey sorry-for pipo, he no dey quick vex, hin love burku, and he dey change hin mind from doing evil. 14. Who know? He fit turn, con change hin mind, con leave blessings—even seed offering plus drink offering for Baba-God wey be una Oga. 15. Blow di trumpet inside Zion, declear holy fast, make una call…
-
Joel Chapter 3
Na Baba-God Dey Judge Di Nations Blessings For Baba-God Pipo 17. “Naso una go take know sey, me Baba-God wey be una Oga dey stay for inside Zion, my holy hill. Jerusalem go dey holy; and foreigners no go fit take over here again. 18. On dat day, di mountains go drop wit new wine, and di hills go flow wit milk. Water go flow for di stream of Judah, and water wey dey flow go burst out from Baba-God house to water bottom-of-di-mountain of Acacia. 19. But Egypt go empty, Edom go be desert of waste land, becos of di fight-fight wey dem fight di pipo of Judah, and…