• Amos Chapter 9

    Di Scata-scata Of Israel Baba-God Go Raise Israel 11. I go plant Israel inside dia own land, and dia root no go ever komot from di land wey I don give dem,” naso Baba-God wey be una Oga—tok. 12. “On dat day, I go build David house wey don kpafuka. I go repair di places wey don fall, and I go build am from scata-scata, con build am as e bin dey before; 13. So dat dem go claim di ramining part of Edom, plus all di nations wey I don call wit my name,” naso Baba-God tok—wey dey do dis tins. 14. Baba-God tok sey, “Days dey come wen…

  • Obadiah Chapter 1

                     Di Judgement Of Edom Dey Come Edom Do Hin Broda Anyhow 10. Shame go cover you becos of di fight-fight against your broda Jacob, you go scata forever. 11. Una stand for one corner and una no gree epp—on dat day wen enemies enta dia gates. Una bad like those strangers wey carry di beta-beta-tins of Jerusalem, becos una share wetin remain for inside Jerusalem. 12. You no suppose look, con dey happy for broda, on di day wey enemies carry dem komot, you no suppose dey happy for wetin happun to di pipo of Judah on di day of dia scata-scata, and you for no make-mouth on di…