-
Jonah Chapter 3
Jonah Preach For Nineveh Di Pipo Of Nineveh Believe Baba-God 5. Di pipo of Nineveh believe Baba-God. Dem declare fasting, and all of dem—from di smallest to di biggest, con wear sackcloth. 6. Wen di gist [news] reach di king of Nineveh, he stand up from hin king-chair, he komot hin cloth, con wear sackcloth, and he sidon for ashes. 7. Naso he con sign law inside Nineveh: “By di word of di king and hin rulers: Make no man or animal, malu or sheep, taste or drink anytin. Make dem no chop or drink water: 8. But make man and animals wear sackcloth. Make everi pesin pray to Baba-God…
-
Jonah Chapter 4
Jonah Con Dey Vex Sey Baba-God Sorry-for Dem