-
Micah Chapter 1
Judgement Against Israel Sadness Plus Cry-cry 8. So I go cry, and I go shout. I go waka about wit-out cloth or slippers. I go halla like dragons, con cry like owl. 9. Becos dem no fit cure Samaria wound; e don spread go Judah. E don reach di gates of my pipo, even reach Jerusalem. 10. Make una no tok about am for Gath, make una no cry at all. Make una roll for dust for di house of Aphrah. 11. Make una waka komot wit nakedness plus shame (as una enemies dey carry una komot)—una wey dey stay for Saphir. Those pipo wey dey stay for Zaanan…
-
Micah Chapter 2
Wahala For Di Pipo Wey Dey Oppress Odas Fake Prophets 6. Dem go tell di pipo wey dey prophesy sey, “Make una stop to dey prophesy or preach, no dey prophesy about dis tins; dis kain disgrace no go meet us.” 7. “Una wey be di pikin-pikin-pikin of Jacob, “Abi Baba-God Spirit get short hand? Abi na dis be hin works? Abi my words no dey do good to those wey dey waka for di correct way? 8. Dis days, my pipo don rise up like enemy. Una dey komot di cloth from innocent neigbours wey dey waka pass, like men wey dey come back from war. 9. Una dey…