• Habakkuk Chapter 3

    Habakkuk Prayer Habakkuk Happy 17. Even though di fig tree no gree produce fruit and di grapes no get fruit for tree, even though di olive plant no gree grow, and di land no gree produce any food, even though all di sheep die from di sheep-house, and di malu-house don empty, 18. But I go still dey happy inside Baba-God, I go celebrate inside Baba-God wey save me. 19. Baba-God my Oga nahin be my pawa; he dey make my leg be like di leg of deer, con epp me climb high places. For di music producer. Wit my music instruments wey get string.

  • Zephaniah Chapter 1

      Zephaniah Prophesy Judgement On Judah Baba-God Day 7. Dey silent for front of Baba-God wey be di Oga; becos di day of Baba-God judgement don dey near. Baba-God don prepare hin sacrifice (Judah), and he don choose di pipo wey he invite (Babylon). 8. Baba-God tok sey, “On di day of Baba-God sacrifice, I go punish di leaders and di princes of Judah, plus all those pipo wey dey wear foreign clothes [follow foreign traditions]. 9. On di same day, I go punish pipo wey dey join idol worship ceremonies, and those pipo wey dey full dia oga house wit bloodshed and wuru-wuru. 10. Baba-God tok sey, “E go…