• Haggi Chapter 1

    Call To Build Baba-God House Again Di Pipo Obey 12. Naso Zerubbabel wey be di son of Shealtiel, and Joshua wey be di son of Josedech, di high priest, wit all di remaining pipo—con obey Baba-God word and di message of prophet Haggai—just as Baba-God dia Oga send am. And di pipo con fear Baba-God. 13. Naso Haggai wey be messenger of Baba-God con give dis message of Baba-God to di pipo, “I dey wit una, naso Baba-God tok.” 14. So Baba-God ginger di spirit of Zerubbabel wey be di son of Shealtiel, di govnor of Judah, and di spirit of Joshua wey be di son of Jehozadak di high…

  • Haggi Chapter 2

    Di Levels Wey Baba-God Promise For Hin New House Di Pipo Don Corrupt 10. On di twenty-fourth day of di ninth month, for di second year of Darius, Baba-God word come meet prophet Haggai sey: 11. “Dis na wetin Baba-God Almighty tok: ‘Ask di priest wetin di law dey yarn: 12. “If to sey pesin carry meat from di holy sacrifice for inside hin cloth, and hin cloth touch any bread or stew, wine, ororo, or any kind of food, abi e go make dat food holy sef?”’” Naso di priest ansa, “Lai-lai.” 13. Naso Haggai ask sey, “If pesin no clean becos he touch deadbody, and di pesin con…