• Zechariah Chapter 1

    Call For Dem To Turn Back To Baba-God         Di Man Among Di Myrtle Trees 7. On di twenty fourth day of di eleventh month, di month of Shebat, for di second year of king Darius, Baba-God word come meet Zechariah wey be di son of Berekiah, di son of Iddo di prophet, sey: 8. “For night I con see one vision—and I see one man for my front wey dey ride red horse! He dey stand among di myrtle  trees wey dey for bottom-of-di-mountain; and oda horses dey for hin back—red, brown plus white horses. 9. I con ask, “Wetin be all dis tins my oga?” Di angel wey…

  • Zechariah Chapter 2

    One Man Wit Line [Rope] For Measurement                    Zion Go Save 6. “Come! Come! Run komot from di land of di north,” naso  Baba-God tok, “Becos I don scata una to di four breeze of heaven,” naso Baba-God tok. 7. “Oh Zion, stand up! And make una escape, una wey dey stay wit di daughters of Babylon.” 8. Becos dis na wetin Baba-God Almighty tok: “He don send me for hin levels, against di nations wey don rob una—becos any pesin wey touch una, don touch di apple of Hin eye— 9. I go surely raise my hand against dem—sote dia slaves go rob dem. Den una go know sey…