• Matthew Chapter 15

    Clean And No-clean Di Canaanite Woman Faith 21. As he komot from dat place, Jesus go around Tyre and Sidon. 22. One woman from Canaan wey dey stay around—come meet am dey cry sey, “Oga, David pikin, sorry-for me! Bad-spirit don enta my daughter body, and she dey suffer well-well.” 23. Jesus no tok anytin. So hin disciples come meet am, con dey ginger am sey, “Pursue her komot, she just dey cry follow us.” 24. Jesus con ansa, “Dem send me come meet only di lost sheep of Israel.” 25. Naso di woman kneel down for hin front—con tok sey, “Oga epp me!” 26. He con tok sey, “E…

  • Matthew Chapter 16

    Dem Ask For Sign Di Pharisees And Saducees Yeast 5. As dem komot go di oda side of di water, di disciples forget to carry bread. 6. Jesus con tell dem sey, “Make una dey careful, shine your eyes for di Pharisees and Saducees yeast.” 7. Dem con dey follow demsef tok di mata sey, “Na becos we no carry any bread.” 8. Jesus know wetin dem dey tok, so he tok sey, “Una wey get small faith, why una dey follow unasef dey tok sey bread no dey? 9. Abi una neva still understand? Una don forget di five bread and di five thousand pipo, and how many basket…