-
Matthew Chapter 17
Di Trans-changing Di Healing Of Di Boy Wey Get Bad-spirit 14. As dem come meet di plenty pipo, one man waka come meet Jesus, naso he kneel down for Jesus front. 15. He con tok sey, “Oga, sorry-for my son, warakpa dey catch am, and he dey suffer well- well, he dey always fall inside faya and sometimes inside water. 16. I carry am come meet your disciples, but dem no fit heal am.” 17. Jesus con tell dem sey, “Chai, dis generation wey no wan gree believe, wey don corrupt, how long I go dey wit una? How long una go dey wit me? Oya carry di boy come…
-
Matthew Chapter 18
Pesin Wey Great Pass For Di Kingdom Of Heaven Di Parable Of Di Sheep Wey Lose 10. “Make sure sey you no use small eyes look any of dis small pikin. I dey tell una sey dia angels for heaven dey always see my Papa face for heaven. 11. Man-pikin don come to save pipo wey lose.” 12. Wetin una tink? If one man get hundred sheep, and one of dem waka-lose, shebi he go leave di ninety-nine for di hill, con go fyne di one wey waka-lose? 13. And if he see am, I dey tell una di truth, he go happy for dat one sheep, pass di ninety-nine…