-
Matthew Chapter 23
Seven Yawa 38. But see as una house don scata finish for una. 39. I dey tell una sey, una no go see me again until una tok sey, ‘Blessings for di pesin wey come wit Baba-God name.’ ”
-
Matthew Chapter 24
Signs Sey Di World Don Dey End No-pesin Know Di Day And Di Hour 36. “No-pesin know di day or di hour, even di angels for heaven no know, even Man-pikin sef no know, but only di Fada nahin know. 37. As e happun for di days of Noah, naso e go be wen Man- pikin go show. 38. Di days before di flood happun, pipo dey chop, dem dey drink, dem dey marry and dem dey give pipo for marriage, until di day wey Noah enta di ark; 39. and dem no know wetin go happun until di flood con carry all of dem go. Naso e go be…