-
Matthew Chapter 25
Di Parable Of Di Ten Virgins Di Parable Of Di Moni 14. “Again, e go be like one man wey wan travel, he call all hin servants, con carry hin moni give dem . 15. He give one of dem five bags of moni, he give anoda one two bags, he con give one of dem one bag, he give all of dem based-on dia level. Naso he komot. 16. Di man wey collect five bags of moni sharply go use hin moni do business, naso he double di moni. 17. Di pesin wey collect two bags of moni—double hin moni sef. 18. But di pesin wey collect one…
-
Matthew Chapter 26
Di Bad Plan For Jesus Pesin Anoint Jesus For Bethany 6. As Jesus dey for Bethany, for one man house wey dem dey call Simon wey bin get leprosy, 7. one woman come meet am wit alabaster box of perfume wey cost well-well, wey she pour for hin head as he sidon near di table. 8. Wen di disciples see wetin she do, dem con vex sey, “Which kain waste be dis? 9. You for sell dis perfume, collect beta moni wey you for give poor pipo.” 10. As Jesus hear wetin dem tok, he con tell dem sey, “Why una dey disturb dis woman? She don do beta tin…