-
Matthew Chapter 27
Judas Hang Hinsef Jesus For Front of Pilate 11. So Jesus stand for di govnor front, and di govnor ask am sey, “Na you be di king of di Jews?” Naso Jesus tok sey, “You don tok am.” 12. Wen di chief priests plus di senior-men dey put mata for hin head, he no ansa dem. 13. Pilate con ask am sey, “You no dey hear wetin dem dey tok about you?” 14. But Jesus no tok anytin, he no even ansa one single tin wey dem tok sey he do—di govnor con surprise. 15. Now, na di tradition for di Festival for di govnor to free one prisoner wey…
-
Matthew Chapter 28
Jesus Raise Up From Di Dead Wetin Di Guards Tok 11. As di women dey go, some of di gaurds waka go di city go report di mata to di chief priests—everitin wey happun. 12. Wen di chief priests plus di senior-men do meeting, con plan, naso dem give di sojas egunje (bribe), 13. con tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Na hin disciples steal hin body for night as we dey sleep.’ 14. If di mata reach di govnor side, we know wetin we go tell am so dat una no go enta wahala.’ 15. So di sojas collect di moni, con do wetin dem tell dem to…